This comic wey dem write for Pidgin talk about wahala of intergenerational, transactional relationship wey dey happen mostly between old men and young girls.
E tell the story of two friends, Anabel and Eve, wey decide say dem go enter relationship with men wey senior dem well-well. Even though dem dey enjoy better lifestyle and plenty gift, Anabel come notice say the relationship no dey sweet her and e no dey feel right. She open up to her cousin, Christine. Christine come explain give her the risk wey dey inside this kind relationship like belle wey person no plan, infection wey fit pass (STI), low self-esteem, and even violence. She still show her why e important to yarn with trusted adult if anybody dey pressure you make you enter relationship.