Adolescent Resource Center (ARC)

UNEXPECTED | PIDGIN

This video talk about the matter of intergenerational, transactional relationship wey dey happen mostly between older men and young girls.

The video tell the story of two friends, Anabel and Eve, wey decide say dem go enter relationship with men wey senior dem well-well. Even though the men dey give dem better lifestyle and plenty gift, Anabel come realize say the relationship no pure and e no dey feel right. She come yarn her cousin, Christine. Christine help her understand the kind risk wey dey inside this kain relationship like belle wey person no plan, sexually transmitted infection (STI), low self-esteem, and even violence. She also show why e important make girl talk to trusted adult if anybody dey pressure her to enter relationship.